Friday 7 August 2015

Friday Splash Of Humour - The Fear Of Boko Haram!


Dem say Boko Haram don poison beans after I buy half bag for house. From the one wey I cook, I give my dog, Bingo, make im first test am, 45mins later bingo still dey waka, dey jolly. 

Na im I come chop my own. After I don chop finish, my gateman run come tell me say bingo don die, hey! I run enter house begin drink full gallon of palm oil for my belle, chop 22 bitter kola wit 3 long bitter leaf stem.

I dey think say my life don finish,I come outside. Na im gate man con dey tell me say the driver wey kill Bingo wan come beg me. 

If na u, wetin u go do the gate man???

No comments:

Post a Comment

Hi there, thanks for stopping by to read this, I hope you enjoyed it. Please feel free to share your views.